MUSIC LYRICS: Cobhams Asuquo – “Everyday” Ft. Sound Sultan & Bez
Enjoy complete lyrics titled “Everyday” from trio A-rated artiste, Cobhams Asuquo, Sound Sultan, & Bez. A calm song in parables. You can give it your own interpretations.
(PRELUDE – Cobhams Asuquo)
Story ooh, story
I wan tell you a story, it happen somewhere wey I know
Three friends dey for village, dem wan find city go
Dem wan go find better life, somewhere way green grass dey grow
Where dem go fit blow
(VERSE – Sultan)
Monkey na workaholic, sit down look na the dog name
Baboon wey be their brother, him mouth sweet pass sugarcane
The same thing wey you tell them, na him make monkey dey slave
And the Dog complain eh eh eh
(CHORUS)
Everyday for the thief, one day for the owner of the house
E fit take time, but one day, one day, Monkey go go market
Sit down looku dey there as Baboon dey run the town
(VERSE – Bez)
Plenty years join together, sit down look dey the same place
Monkey work till retire, e no get leave, e no get pay
Baboon dey just dey flenjor, throw Banana, throw dem bone
But e dey chop alone (chai! thats not fair)
(CHORUS)
Everyday for the thief, one day for the owner of the house
E fit take time, but one day, one day, Monkey go go market
Sit down looku dey there as Baboon dey run the town
(HOOK)
E dey run the town ooh
E dey run the town ooh
(CHORUS – Cobhams Asuquo)
See, Everyday for the thief, but one day for the owner of the house
E fit take time, but one day, one day, Monkey go go market
E go dey sit down look for Tv as Baboon dey run the town
(CHORUS)
Everyday for the thief (Everyday, everyday) one day for the owner of the house
E fit take time, but one day, one day, Monkey go go market
Sit down look for Tv as Baboon dey run the town
(FINALE)
oh oh oh oh oh oh oh…
Everyday for the thief, (for the thief oh oh oh) one day for the owner of the house
E fit take time, my brother passess time go go market
Sit down look for Tv yea eh eh: Sit down look for Tv as Baboon dey run the town